To continue using the site you need to read the revised version and agree to the policies
1 minute, 59 seconds
-1 View 0 Comments 1 Like 0 Reviews
Part 2👇🏽
8. Grace Mugabe – Zimbabwe
A whole First Lady wey dey slap people inside mall. She dey plan to take over from Mugabe sef. But once military knock door, her influence turn dust. Next thing: exile.
9. Leila Trabelsi – Tunisia
She loot Tunisia dry. Her family dey control everything. But when revolution start, she run leave country. Na ordinary people she once insult dey drag her name for street.
10. Asma al-Assad – Syria
Once “Rose of the Desert,” now global symbol of hypocrisy. Beauty cover no fit hide wickedness. Sanctions full her head.
Madam Remi
Power sweet, but e dey finish.
The nonsense you pull for Osun with Adeleke show say you don dey drunk on influence. But make you shine eye: history dey full of First Ladies wey think say dem be goddess, until power shift and world remind dem say dem be ordinary human being.
From Mariam Babangida to Imelda Marcos, from Mao wife to Marie Antoinette, from Patience Jonathan to Grace Mugabe — the story no dey change.
Power no be inheritance. Influence no be blood group. E dey finish instantly once the man leave office.
So check yourself. Because history no dey kind to women wey use borrowed power take oppress people. The seat go end. The cameras go off. Na only your actions go remain.
~Peter Reformed (Rant HQ)